Thursday, April 18, 2019

Video+ Photos:Generator Thieves Caught & Beaten In Sapele


 
Two thieves terrorizing Itsekiri Road in Sapele, Delta State have been captured by able youths, beaten and handed over to the vigillantee group.

Sapele Oghenek shared the news on social media and wrote:

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER

18/04/2019

EVERYDAY FOR THE ABOKI THIEF, ONE DAY FOR THE OWNER

We don too announce the way dem take dey disarm people goods for this forum and the way dem also dey fling people phones and dey use dagger dey attack people dey collect their phones and other belongings. Just this early morning nai hand touch two (2) Aboki as area people catch dem.

Na around 5 30am today for Itsekiri Road nai dem hold the two Hausa Boys, dem go thief Generator. Na when dem catch dem, nai dem con dey change mouth say na one woman nai give dem.

Na for where the guys wey catch dem con tell dem say oya make dem march alele to go show dem the woman wey give dem the generator, before dem know, the two Hausa Boys con dey run. Nai the boys give dem hot chase as dem chase dem from Itsekiri Road and catch dem for Yoruba Road by dem koffi house. Dem beat dem and parade dem small before dem call Vigilante and hand dem over to Police.

We wan commend the guys wey dem do this apprehending as dem always dey vigilant to strange things wey dey happen for their areas. We salute Bayo, Festus Kabaka, Boyo Boy, Austine Bullet wey be broda to Paul Idon and Koffi wey dey for Yoruba Road, as all of dem put hand together to catch the two Hausa thieves.

We hope say more areas go beef up their security to apprehend criminals wey dey terrorize dem. This na eye opener to other people wey dey indulge for crime especially those wey dey fling phones and bags and those wey dey disarm and kill bike men, unu cup go soon full. Na me talk am oooo. Make unu bet am!!!

We hope say this issue dem nor go sweep am under carpet most especially as he concern Awusa people so?

WATCH VIDEO

No comments:

Individual credits from monetary organizations ascend as expansion chomps harder

  Proof has arisen that Nigerians impacted by the increasing cost for most everyday items are getting credit offices from monetary foundat...